LAYRAYNEWS

News, Events, Entertainment, Lifestyle, Fashion, Beauty, Inspiration and YES LAYRAY GIVE-AWAY

Saturday, 27 June 2015

BV COLUMN - BREAD AND EGG WAHALA


Abeg, I wan knack you and my fellow BVs, this tori ooooo, as I remember am I dey laugh, if I win the N5, 000, it won’t be a bad idea oooo, lol. I never see time write am since because of my exams.

TO THE MAIN GIST
A few weeks back, it rained in the morning, so I was late. As I wan  park for office, my phone ring, grrrrrrrinnnn, as I look am, na our office number, my heart don cut say, maybe my Madam dey call me, EMATT (Electronic Madam At The Top… as one of my colleague who introduced me to this blog dey call am), lol. 
As I pick am, na our Receptionists R… and G… , “Aunty J… we dey go buy Bread and Fried Eggs, with Breakfast Coffee, we wan find out whether you go buy” na there my set up start ooooo. R and G sabi say I like Bread and fried Eggs, well well and R sabi make the breakfast coffee, very creamy for me. 
Before I park finish, dem don come downstairs, before you say “Jack Robinson”, I don rush out of the car, carry money give them. When dem return, I enjoyed my meal and carried on the business of the day as usual. Meanwhile, I be dey prepare for my seminar presentation for school that day. Around 4 pm, I carry my things, (I dey close early on the days I go to school) to go pick up mu daughter, drop her with my aunt and go to school. Na so I begin find my car key, I check my bag, bring our everything, like 3 different times, begin pray sef, say every plan of the devil to make me go late for my presentation, catch fire.
All my colleagues don begin follow me find the car, including a BV, when be Iya Ibeji, she carry her big belle, come follow me check everywhere ooooo, where you put key, I say, I usually keep it on my desk or my bag. I begin demonstrate, think how I take climb up in the morning, sign register, ehen, I was holding the key na, go reception, check for where?

I was already planning to beg my colleagues say if na prank, today no be day for pranks oooo, I wan go do crèche runs, before I go school for presentation, because, for my office, dem sabi dat kain prank. (na so one day dem hide one of my Male colleague wallet, I no dey office ooo, but as dem gist me, I laugh ooo – story for another day). 


WAITTTTTTT, my mind say abi, you forget key inside car, I say NEVER, how na, I never forget key inside car before. My mind say, just check to be sure. Na so I rush downstairs, as I reach downstairs, the key was still in the ignition, e remain small, I for no off engine, because of egg and bread chai….

Na so me and my receptionist and my Male Colleague, Mr. P… turn to panel beater oooo, any way, we brought out the key ourselves ( don’t ask me how oooo). I jump inside motor go pick up my baby go school. As I dey go, my Colleague send me text say ” .. tomorrow you go still do longer throat for bread and fried eggs..” I burst laugh ehen.

My Fellow BVs take care ooo, till next time.

Amebo Lawyer, looool.

No comments:

Post a Comment